Logo
Mimia
Dem go sell for one auction, six of di shirts wey Lionel Messi wear during Argentina World Cup-winning campaign for Qatar.
36-year-old Captain Messi bin lift di trophy afta im side beat France on penalties for last December World Cup final for Qatar.
Di shirt wey e wear for di final match dey part of di set dem wan sell. E dey expected say di shirts go fetch more dan £8m for di auction wey Sotheby dey host for New York.
Messi shirts go dey on view for Sotheby New York headquarters for one free, public exhibition during di bidding process, wey dey open between 30 November and 14 December.
Sotheby tok say dem go donate part of di money from di auction to meet di needs of children wey dey suffer from rare diseases."
Messi, na eight-time Ballon d'Or winner, e become di first player for World Cup history to score for di group stage, last 16, quarter-finals, semi-finals and final of a single tournament.
10 months ago

No replys yet!

It seems that this publication does not yet have any comments. In order to respond to this publication from Mimia , click on at the bottom under it